Vendor Access Code

Your business dey secure, your account sef dey secure with our unique vendor code for each and every of our vendors/shop owners weh dey use StockBank, After you don request all the goods weh you go like come carry, we go request seh make you enter your personal StockBank vendor code weh we send give when you register. We go request the code for warehouse before you go fit carry all the goods you request.

Two-step Verification

We go require make you set up your 4 digit pin after registration, na this pin you go dey press anytime you wan open our app do anything on-top am.

No tell person your pin make dem no steal your account.

Goods Recovery Policy

As part of our policy, we no dey embarrass our vendors/shop owners if dem no pay after 3days or one week period don pass depending on which category a vendor falls in, we go come your shop without making noise to come pack goods worth the amount of goods weh you collect weh you never clear after the grace period we give you don pass.

If we come recover goods from your shop because you no clear your outstanding, you no go ever get access to StockBank again.

Recover your Account

If you loose or you misplaced your phone, borrow person phone to login your account take clear your outstanding payment or request for goods, you go enter your Moniepoint account number and your Stockbank password weh we send you for your phone when you register.

Na 2 things we go send you after you don register, we go send you your password when you register by yourself ontop our app, we go later send you your StockBank access code after your Responsibility Officer from StockBank come your shop to come verify all the detail weh you fill during registration, write everything we send you down for book keep for safe place. Delete the message after you don cram am put for head. You fit change your password to the one weh you like for your profile area ontop our app, we go request make you enter the one weh we send you before you go fit change am.