For example;


Step1
Mama G get provisions or foodstuffs shop for area and she don register for StockBank using STOCKER mobile App weh she download ontop her phone.


Step2
After she don submit her details ontop STOCKER, we go come her shop to come verify seh all the information weh she provide
give us online dey true, we go finalize her registration and we go send give Mama G her personal StockBank access code, na
this code only her go dey use take dey request goods from StockBank.


Step3
Mama G go carry her phone open STOCKER or she go tell her next of kin or her pikin make dem help her begin select products weh she want, the process no hard, e dey simple. Mama G go press SUBMIT only when she don ready to go carry all wetin she request.

Step4
Mama G go receive message for inside STOCKER to come carry her goods from the location weh near her shop,we go tell Mama G the 2 days of the week weh she go dey come collect goods if she request.


Step5
Mama G go come the location weh we tell her for insde STOCKER, she go follow direction weh map dey tell her or she go chat for inside STOCKER to request direction from her officer. We go request for her personal StockBank access code weh we send give her for phone when she reach our warehouse. we go dey ask for this code anytime weh she come collect goods or she send pesin come collect goods weh she request.

We dey advise make you no reveal your code give any body except person weh you trust, make dem no come use your account collect goods without your consent.

StockBank dey give 3 days or 1 week to sell before you go clear yourself of the goods weh you collect come collect another set of goods.